Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience
|
|
Emenike go face Gunners
Na anybody wey win dis play off match between dis two ogbonge teams na hin go carry dia bag enta de group stage for ness season Uefa champions League.
Na de Supa Eagus strika, Emmanuel Emenike wey no dey hia word at all na him go cause de yawa for de Gunnas as de guyman juss U turn go join him foma club (Fenerbahce) on Wednesday.
Na £13 million na hin Fenerbahce take knock de door mouth of Spartak Moscow bifor de Russian club kon gree allow make de Naija man kommot for dia side.
Emmanuel Emenike na danger man and na everybody know de kasala wey him fit cause for any team wey him go face for any match and make unna no forget say na him be de Baba for gols for de 2013 African Nations cup.
No be today na hin Arsenal don dey play 'play off ' bifor dem go kon kwalify enta de champions League group stage, but dis season own don get K leg now for dem bicos of dis sabi strika, Emmanuel Emenike.
Na August 20 and 21 na hin dem go play de fess leg while na August 27 and 28 be day for de second leg.
Walahi, plenty Arsenal fans don dey catch cold wen dem hia say na Fenerbahce na hin dia team go jam and na de fear of Emenike na hin enta dia body.
Arsenal fans, unna go fit qualify for ness season champions League so? Abeg make unna no vex ooo if de query dey pain you.
No comments :
Post a Comment
Disclaimer: All the comments on this blog are the personal opinions of those who have comment it (commentators)
--------------------------------------------------------------------------------------------
Advertise with us: E-mail: enyinnayaemma@gmail.com
Note: only a member of this blog may post a comment.